Tuesday, 31 May 2016
MASSOB GBEGE POLICE DEM FOR ASABA DELTA STATE.
Na 7 pipu we hear say pooff onto the Gbege wey the Movement for the Actualization of Sovereign Biafra(MASSOB) cause for Asaba Delta State yonder.
The PPRO of Delta SP Charles Muka confirm say Police dem loose 2 men, but 5members of the MASSOB dem sef don pooff as military pipu face some of the protesters along Asaba-Onitsha expressway.
He still yarn say the military pipu dem arrest 8 members of MASSOB and dem don dey carry out investigations. He say the protesters just begin Gbege Akelebe team dem wey dey ground to make sure say no wahala for dat area, but dem the protesters just vex attack Akelebe dem, pooff 2, wound 2.
Dem poof one Akelebe wey na corporal, con take him AK 47 riffle around Okire Junction for Abraka, Asaba. The protesters still attack one Akelebe along Denis Osadeby road, Asaba, dem would am con collect him anti-riot gun.
The group later attack 2 other Akelebe wey dem suspect say go be Marine Police, con throw the two of dem inside the River Niger for Cable point, Asaba. One Akelebe pooff, dem save the other one onto the matta.
Muka confirm say stray bullet Nack one pregnant woman, but she don dey recieve and respond to treatment now for inside Federal Medical Center, Asaba. He don warn all parent to watch dem children, becos anybody wey dem catch in connection with this matter go hear am hot.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment