Pages

Wednesday, 18 May 2016

SEVILLA DON WIN UEFA EUROPA AGAIN




Defending champions of the UEFA Europa League don defend dem championship again after dem beat Liverpool 3-1 to defend dem title for the 4th time.

Na Liverpool been lead for first half as D. Sturridge put Liverpool for front before the end of first half. Sevilla enter second half as K. Gameiro sharperly score for 46 mins inside second half.

Liverpool dey play with everything dem get, but Sevilla wey  just Dey play ordinary just Dey score as dem make am 2-1 inside 64mins, before thesame coke wey score the second goal, con make am 3-1 as he score the third goal for 70 mins to end the game for 3-1.

This winning now make am the fourth time wey Sevilla go carry dis cup back to back like say na dem the cup dey for.

Sevilla go meet Barcelona on sunday to play the final  of the Copa de rey for Spain yonder.

No comments: