Pages

Wednesday, 18 May 2016

JTF DON RESCUE ONE OF THE CHIBOK GIRL.


After Boko Haram kidnap those girls for chibok community since April 2014, civilian JTF don help rescue one of the girl wey her name na Amina Ali.
The JTF wey rescue her see her say she dey breast feed Pikin of four months as dem rescue her with her boko haram husband for inside Sambisa forest wey near Cameroon boarder on Tuesday.

Amina Ali wey dem confirm say she be from Mbala community near chibok and she be one of the girls wey Boko Haram kidnap from the chibok school 2014. Amina Ali yarn say some of the chibok girls don marry while like six girls don pooff.

Oby Ezekwesili wey be convener of the Bring Back Our Girls don yarn to rejoice the rescue of one of the chibok girls wey be Amina Ali.

No comments: