Pages

Tuesday, 28 June 2016

10 PIPU POOFF, MANY WOUND FOR THE ISTANBUL AIRPORT SUCIDE ATTACK.


Gist dey say na 2 pipu just carry kalashnikov begin spray pipu bullet for Ataturk Airport, Istanbul, Turkey before dem blow dem sef throway. 
Dem say the attackers dem just go the airport begin shoot-shoot pipu anyhow for Ataturk airport inside Istanbul, dem say the attackers begin move enter the security checkpoint of the airport before police begin shoot dem, but dem blow dem sef throway with bomb.

Justice Minister, Bekir Bozdag yarn for one parliament say him fit confirm say na 10 pipu pooff and 20 pipu wound as the 2 attackers begin spray bullet anyhow before police for yonder come show.

He yarn say the police pipu dey shoot dem so dat dem no go fit enter the checkpoint to curse more damage, before dem blow dem sef throway with bomb as the matta don red.




No comments: