Thursday, 23 June 2016
POLICE AND ARMY GBEGE BECOS OF BAG OF RICE FOR MAIDUGURI GOVT HOUSE.
No be small matta for the government house for Maiduguri as police and army Gbege becos of bag of rice wey the state government dey share give Internally Displaced Persons IDP wey no dey camp.
Na since one week the sharing of rice don dey happen for inside the Government House and police dem dey always make sure say the Rice share reach everybody wey come collect. The Rice sef dey help people for the state to fit cope with the hard situation of the country.
But today, one Army truck drive enter the Government House con dey demand for rice too, the police dem wey dey on ground con ask the army people for permission note, but the army dem no get, so the police no gree give dem, na dat time the Gbege start.
We hear say shooting sef involve for the Gbege, but nobody pooff onto the matta, na only one Akelebe wound as the Gbege dey hot.
Every don cool down now sha, but the state Government do decide to suspend the sharing of the Rice till further notice.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment