Sunday, 3 July 2016
SEE TREE WEY DEY PRODUCE WOMAN SHAPE FRUITS FOR THAILAND.
One strange tree wey dey produce green fruits wey get the exact kind shape of young woman don show for inside Thailand.
Internet don burst with the tori, as some believe say na Nariphon from the Buddhist Mythology, but many pipu dey surprised about the strange fruit as dem never see fruit wey get woman shape before.
For Buddhist Mythology, the tree wey dem dey call the Nariphon dey bear the fruit of young female creatures and dem say the tree dey only grow inside the mythical forest wey dem call Himaphan.
According to the myth, one Buddhist God, Indra been create 12 special Nariphon trees wey go dey bear fruit with him wife Vessantara image to terrify male creatures for the forest. Even after the couple dem pooff, the Nariphon tree still dey continue to bear fruits wey get woman shape.
*Na wa O!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment