Customs officers don discover another container wey dey filled with Guns for the Tin Can Island Port inside Lagos.
According to reports, na 440 pump action rifles dey inside the container wey dey import from Turkey. Dem don gbab One suspect and arrest as investigations still dey ongoing. Una remember say for January, Customs officers discover 49 boxes wey contain 661 pieces of Pump Action Rifles inside one container for the Tin Can Island port.
No comments:
Post a Comment