Pages

Wednesday, 31 May 2017

Oshodi War: Na the pooffing of Oshodi politician and NURTW boss, Rasaq Bello dey cause gbege so.


Gbede happen for Shogunle, Oshodi on Monday, May 29, 2017, as the APC primary wey happen for Shogunle town hall inside Oshodi turn gbege wey cause the ultimately death of
popular politician and NURTW oga, Rasaq Bello otherwise aka 'Hamburger'.
Reports dey say the late Rasaq Bello chop bullets from members of rival gang wey one Samson Agbetoye, aka 'Golden' lead.
As Hamburger pooff, some residents say no be small gbege dey happen for dat area since the matta happen so. Yarnings dey say the rival gang go find 'Golden' wey don run since, but as dem no see am, dey pooff him mama. Gist dey say the popular Ladipo market been dey shutdown and heavy presence of Police patrol vans has been dey all around Oshodi.
Before he pooff, Hamburger na the Lagos State Treasurer of Tricycle Operators, one branch of NURTW. They just make am chief when dey give am title of Akinrogun of Shogunle.
Since then, the area dey hot and pipu still dey waka with fear becos dey no know werin fit happen at anytime.

No comments: