Pages

Wednesday 2 August 2017

NEWS: BADOO don strike again, dis time na for Ojodu Berger, dey pooff one man with him pregnant woman.


Na two lovers BADOO pooff today for dem house wey dey Hassan Abiodun, Ojodu Berger, Ifo Local Government Area of Ogun State early dis morning.

Plenty pipu don gather dey cry as some say dem been hear as the BADOO dey use grinding stone burst the head of the couple dem, the couple been dey plan to do dem marriage very soon, before the matta happen so.
Gist dey say na one storey building the couple dem dey stay, before the BADOO come attack dem dis morning.
Policemen from the Ojodu Abiodun division don land the area to move the bodi dem go the General Hospital wey dey Sagamu.
The spokesperson for the police for Ogun, ASP Abimbola Oyeyemi, phone number no go as pipu dey try call am to hear from am as the matta be, but the number dey switched off since.

No comments: