Tuesday, 8 August 2017
NEWS: Na failed Drug Deal cause the gunmen attack for Ozubulu Catholic church Anambra.
Gist don dey say the gunmen wey attack Ozubulu Catholic Church for Anambra attack becos of failed drug business wey two South Africa-based drug barons been do.
Even the Police sef dey reason say na the failed drug business fit cause dis kind shooting spree.
Dem don identify one man with him aka Bishop, and one of him brother wey come from the community and pipu know am as Obrocho, the two of dem base for South Africa, and dem be serious drug barons. The gbege happen after one drug deal wey dey do fail, na so dem two begin dey reason cheating for the matta.
Onto the matta as e dey hot, one of the men just vex send assassins to pooff Bishop wey just enter Nigeria for visit. As the assassin and him gang members land Bishop house, dem no meet am, so dem track him Papa wey be Chief Akunwafor Ikegwuonwu down for church for the morning mass. Dey just vex shoot and pooff the papa and plenty other church members.
The state police commissioner, Garba Umar, don dismiss allegations say na Boko Haram members been cause the attack. Umar yarn newsmen say the church members say the gunmen speak Igbo for the attack.
Eleven people have so far don pooff onto the attack.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment