Pages

Thursday 10 August 2017

NEWS: Woman born pikin for Kenya polling station, she name her baby girl 'Ballot'


Yesterday, Paulina Chemanang one Kenyan woman born one fine baby girl as she dey wait to cast her vote for the Kenya election.

Na some voters for the Konyao Secondary school for west Pokot help her deliver the baby girl before dey rush her go hospital for beta treatment.
Surprisingly, she come back by hersef to vote na so Kenya Capital Fm interview, she yarn say 'having given birth at a polling station is a blessing to me and I thank God'.
She don name her baby Chepkura. "Kura" wey mean "ballot" or "vote" for Swahili.

No comments: