Pages

Thursday, 3 August 2017

SPORT: Neymar don Join PSG for '€222m Move Deal', na No. 10 jersey he go wear for PSG.


Barcelona don finally confirm the movement of Neymar to PSG after plenty rumors onto the transfer matta. Now Neymar don join PSG for the transfer fee of €222 million release clause.

Neymar been go the training ground of Barcelona, but later commot, the club later tweet say "Neymar Jr. has been given permission not to attend training." As Neymar dey commot from the training field, he wish all him Barcelona teammates bye-bye.
PSG dey happy for say dem just sign Neymar and dey want make he dey wear Tue No. 10 Jersey wey Pastore been dey wear for the club to welcome Neymar.
As e be now, news dey say Barcelona dey fight seriously to make sure dem sign Philippe Courtinoh from Liverpool as possible replacement for Neymar.

No comments: