Sunday 1 May 2016
AKELEBE (POLICE) GBAB ONE MAN FOR ANAMBRA, AFTER HE KPAI HIM BROTHER
Na wa O! This man name na Mr. Chukwudi Mmadukor, Police gbab am unto say he KPAI he younger brother wey he name na Chinecherem Mmadukor wey na just 18 years old.
For D post wey Chinedu Akwaeke post for Facebook "wicked people no go know peace, sake of say Akelebe don gbab one Mr. Chukwudi yesterday unto say he kpai him junior brother codedly for 2015 con still bury am with D help of two of him other friends inside one Bush side for Ibughabu /Umumze Bush for yonder". After Akelebe gbab am, he confess say na kpai him brother. The D. P. O mr Ojo Anthony say Mr Chukwudi don gree say na him kpai and bury am, but dem still dey investigate D Matta.
People wicked sha!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment