Tuesday, 24 May 2016
C. RONALDO SAY HIM GO DEY FIT BEFORE SATURDAY UCL FINAL AFTER HE GET INJURY FOR TRAINING
R. Madrid star C.Ronaldo don yarn say him go dey fit before Saturday Uefa Champions League Final with A . Madrid.
C. Ronaldo been get small knock for him leg as dem been dey train onto the UCL Final match wey dem go play with dem rival A . Madrid for inside Millan on Saturday.
C. Ronaldo no fit complete him training as he get small injury for him lap, but he don yarn say him go dey fit before Saturday and all dis injury matta dey happen now becos na him R. Madrid dey use pass for every match.
He say make him fans no worry as him go make sure say him play the final of dis Ogbonge Match.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment