Tuesday, 10 May 2016
GOBE!! CULT BOYS DON POOFF ONE ONYABO OGA FOR AGA, IKORODU, LAGOS
No be small matta yesterday for one side wey be Aga for inside Ikorodu, Lagos as cult boys go pooff one Afeez Oseni wey be oga of Onyabo Vigilante group for yonder.
Afeez wey be leader inside Onyabo Vigilante group pooff yesterday as cult boys track am for where he dey for Aga Ikorodu, where dem shot am anyhow con still stay to confirm say he don really pooff before dey move. The leave Afeez dey swim inside him own blood.
Now the Onyabo Vigilante group don dey Para (vex) say dem go do everything to make sure say dem gbab the cult boys wey poof their leader. We hear say as the matta happen, everybody sharperly close shops and rush go house as dem dey fear wetin fit happen after the poffing of the Onyabo leader.
Ikorodu pipu say the matta don tire dem sef, say dis cult boys too dey worry dem for that Aga area and the matta dey worse everyday.
For now, Akelebe never yarn anything about the matta.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment