Pages

Monday, 9 May 2016

MAN WEY POOFF HIM WIFE FOR EGBEDA DON YARN O!


One Mr Lekan Shonde wey pooff him wife for Egbeda Lagos don yarn say na he wife provoke am O!
Lekan wey be worker for Apapa Deport say he wife wey her name na Ronke wey he pooff so don be he wife for 8years and dem get 2 children wey be 6 & 4 years old.

He yarn say he mama been don warn am make he No marry Ronke, but he No hear. The late Ronke provoke am as she dey yarn how her lover take straff (sex) her inside hotel for Abuja.
He say Ronke wey pooff so no dey gree let am touch her for straff and say she begin misbehave since March when she start to dey follow one one General Manager of one Publishing Company. He yarn say he No pooff him wife lock gate as pipu dey yarn, say na he Pikin lock the gate.

He say no be say he like pooff he wife O, after all the yama-yama wey he wife been dey do am, dem get small quanta, she con dey hold he cloth, as he commot her hand from D cloth, He con push her small for staircase and dat time nothing do her, but on Friday as he dey commot he see her for staircase and he think say she still dey pretend.
He say no be as he think am, say the wife no dey respect and appreciate am like before again as she begin follow the General Manager.

More stori later...

No comments: