Pages

Sunday, 22 May 2016

PRESIDENT BUHARI NO GO SHOW FOR LAGOS ON MONDAY AGAIN


Naija President, President Muhammadu Buhari wey suppose show for Lagos for two days visit to commission some project on Monday no go fit show again.
Buhari no go fit show Lag again as dem be plan to welcome am for Lagos. The reason President Buhari take cancel the visit na say Him want make dem reschedule the visit sake of tight schedules.

Meanwhile, President Buhari don send him VP Wey be Yemi Osibanjo to represent am for Lagos. VP Osibanjo go show for Lagos to commission some of the project dem, but he go leave some for the President to later come commission.

We hear say President Buhari go still come Lagos, but that visit go be after the Ramadan. VP Osibanjo go commission some project, leave the remaining for PMB when the time come

No comments: