Sunday, 8 May 2016
TRAFFIC YAPA FOR LAGOS-IBADAN EXPRESSROAD SAKE OF CONSTRUCTION WEY DEY HAPPEN THERE
Oboy! No be small traffic yesterday for Lagos-Ibadan express road as we hear say the Lagos state government dey renovate one side of the road.
As the construction dey go on, na one lane dey opened for all motorist to follow, dat one cause big gbege as the hold-up no be here.
People just Dey complain sake of say some dey use reach 3hours for one spot.
The Lagos traffic pipu wey be LASTMAN dey ground to help clear road for motor dem to fit manage pass. The construction of the renovation wey dey happen for the road so na to beta the movement of pipu wey dey waka dat road wella.
The Lagos state Government don yarn say make me pipu just patient small sake of say the renovation na for the betterment of everybody.
See more foto...
Foto: punch news
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment