Monday, 27 June 2016
AGUERO AND MASCHERANO WAN JOIN MESSI TO RETIRE FROM NATIONAL FOOTBALL.
After Argentina loose to Chile for the second time inside the Copa America final wey just happen so, Messi wey be the captain of Argentina vex yarn say him no play national football again,
Now, Aguero and Mascherano sef dey reason to retire from National team football. Aguero yarn say na manage dem take reach final sef bcos na the worst dressing room wey he don ever play with be dis present squad wey Tata Martinez wey be dem coach lead. He yarn say him sef dey reason join Messi for retirement too.
Barcelona teammate Javier Mascherano sef dey join the retirement list as the loose to Chile really pain am sake of say na the third final of Copa America wey him dey loose with Argentina be dis and he feel say na time to move on with him club duties.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment