Thursday, 30 June 2016
ENGLAND WAN SIGN EITHER ARSENE WENGER OR RENERI AS DEM NATIONAL COACH.
England FA dey try restructure dem team, and dem dey believe say dem fit sign another coach after Roy Hudson resign. Now na Arsene Wenger or Claudio Reneri dem wan sign.
So far, na Asene Wenger be the most favorite to sign now, because he name just Dey ring bell for everywhere, as England FA DON decide to get new coach. The FA believe say Wenger go fit help dem groom the young players dem wey dey the England team now.
The issue now na say, Arsene Wenger go fit commot from Arsenal? The coach don relax for the club and him no get any wahala with the club management board, and as we know, Arsene Wenger dey fear sack, and him know say if he No try with England national team, dem fit sack am.
The matta now na say, na good thing for Arsene Wenger to commot for Arsenal con begin coach England? We go dey monitor the movement as e dey go sha..
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment