Pages

Thursday, 30 June 2016

PORTUGAL BEAT POLAND 5-3 FOR PENALTY TO QUALIFY ENTER DEM FINAL.


No be small matta for the Euro 2016 as Portugal face Poland for the quarter final, but na penalty decide the end of the match wey end 5-3 to qualify Portugal enter semi final. 
Na Robert Lewandowski first open the net for Poland inside the first half, but sanches equalize for Portugal before the first half end. The first half end 1-1,but the second half no get any goal atall.

For inside the second half, Portugal con dey serious with the game, dem Play Poland wella, but C. Ronaldo loss two chances wey for seal the game for dem instead of to play extra time and penalty.

As the second half end draw, the match enter extra time, from extra time, e enter penalty. Na C. Ronaldo wey be the captain of Portugal first play and score him penalty, the penalty later favor Portugal as dem win Poland 5-3 to qualify enter the semi final of the Euro 2016.




No comments: