No be small matta for Ikorodu road, Maryland as one trailer pooff Street hawker wey dey try run from KAI official.
The trailer squash the hawker as he pooff for the spot. Na eyeglasses the guy dey sell for hold-up along Ikorodu road, Maryland Dis afternoon.
As the matta happen, many other hawkers vex Block road con begin dey destroy BRT buses as dem dey vex. No single one Kai official dey the scene of the Gbege after dem see say D hawker wey him name na Nnamdi don pooff.
Na stones other hawkers take dey spoil any BRT bus wey pass, dem destroy some windscreen of BRT bus.
Till now, Kai never yarn anything about the matta.
I


No comments:
Post a Comment