Pages

Friday, 24 June 2016

IKORODU BREAKING NEWS :NA LIKE 15 PIPU POOFF FOR IGBOLOMU, AGRIC.


No be small matta for Igbolomu, Agric, Inside Ikorodu overnight as some pipeline vandals burst the area, con pooff like 15 pipu overnight becos dem wan come steal level for the area.


Some pipu wey dey stay the area yarn say na heavy machine guns dem the vandals carry come attack the town. We hear say the vandals attack the area, kill about 15 pipu and some of the pipu na pipu wey dey go for prayers and some wey just Dey come back from work. As of now, no police presence for the area and pipu wey still dey there as dem no get where to run dey fear of wetin for later happen. Some reports say the vandals na ijaw boys wey wan come steal fuel for the area.

Some pipu no even fit sleep dem houses becos of the matta, while some pipu, both landlords and tenants dey move commot for the area.

*the pix no be the original pix of the incident, more pix later sha*

No comments: