Pages

Tuesday, 28 June 2016

INIESTA SEF DEY REASON TO RESIGN TOO, AFTER MESSI SEF ANNOUNCE HIM RESIGNATION.


After Italy beat Spain 2-0 for inside the Euro competition to commot Spain wey be the defending champions from the tournament, Barcelona mid-fielder, Andres Iniesta sef don dey reason to resign.
The matta dey come after him Barcelona team mate, Messi sef announce him retirement from National football as Chile beat dem for the final of Copa America. Players like Zlatan Ibrahimovic, Sergio Aguero, Javier Mascherano, Messi and now Iniesta don yarn say dem wan retire from National football.

Iniesta own dey come as surprise, as people no too believe say he go yarn about retirement yet becos the Spanish team still dey gbadun him service. Iniesta say na time for him to move on as he feel say he don try small for Spain. He yarn dis yearnings after Italy wipe dem 2-0 to commot dem from the 2016 Euros wey dey happen for inside France.

*abeg who go be next?*





No comments: