Pages

Thursday, 23 June 2016

JAMES RODRIGUEZ DEY PLAN MACHESTER UNITED MOVE


We dey hear say e be like say Real Madrid Player James Rodriguez dey plan Man Utd move as he dey find house for Golden Triangle Estate near Manchester.


The gist dey say Jose Mourinho like the player and he No mind the move atall sake of say the two of dem don know from Madrid before and he No mind spend £30million to sign the player.

Mourinho don tell the agent of James, Jorge Mendes say make he try convince James come Man Utd as R.Madrid no wan gree give am new contract yet. We hear say Mendes dey ask R. Madrid new contract for James, but R. Madrid never gree answer dem yet, so na good opportunity the player to fit move since e dey be like say R. Madrid no want him services again as stars sef too much for the team.









No comments: