Pages

Friday, 24 June 2016

MOURINHO DEY TABLE £35MILLION FOR AARON RAMSEY OF ARSENAL


New Man Utd boss, Jose Mourinho dey offer £35million for Arsenal playmaker Aaron Ramsey, even though Mourinho and Arsene Wenger no be padi at all.
Reports dey say na Ramsey performance for dis Euro 2016 wey dey happen for France interest Jose Mourinho, as Ramsey dey represent Whales and he dey really play well to help him team. Jose Mourinho yarn say him need mid fielder like Frank Lampard, and him see thesame quality inside Ramsey, plus say Ramsey fit even do more.

Becos of the Gbege wey Mourinho and Wenger get, Jose Mourinho don yarn with Ed Woodward wey be the oga Pata-pata for Man Utd to follow Arsene Wenger rub-mind, so dat  dem go fit sign Ramsey enter Man Utd.








No comments: