Pages

Thursday 9 June 2016

NA 39 YEARS IMPRISONMENT COURT DASH DIS BANKER WEY THIEF #33M FROM DEAD CUSTOMER.


Justice Oluwatoyin Ipaye of the Lagos State High court don sentence Mr Olawale Garuba go 39 years imprisonment.
Na yesterday dem slam the sentence ontop Mr Olawale Garuba Head, sake of say him follow plan with 6 other pipu to thief #33M wey one of dem dead customer get with dem bank. Na dis new generation banks dem, but dem code the name sha.

Mr Garuba and the 6 others plan the thiefing of the money from the dead customer account since July 2015.

*abeg, what of the pipu wey dey thief billions of naira and dollars from living Nigerians, wetin happen to dem case? *


No comments: