Pages

Wednesday 24 August 2016

'I NO KNOW WETIN I DO TO OFFEND SPORTS MINISTER DALUNG' -SAMSON SIASIA


Under 23 Olympics Bronze winning coach Samson Siasia yarn say he dey surprise too about the Gbege between him and the Sports Minister Barr. Solomon Dalung.
Siasia get social media Gbege with the Minister after the coach complain of the poor treatment and financial incentives he and him  players receive towards the Olympics for Rio, Brazil, wey con make the minister to say he No dey aware of where the team dey for pre-Rio and even say he go discipline the U-23 national football team coach, Samson Siasia and every other team official wey join the media to yarn dem frustration, say dem dey unethical.

Siasia now don say he No know the offense he commit to the minister . “As we dey yarn, I no know wetin I don do to offend the Minister. The whole thing na surprise”, Siasia yarn so for Johannesburg Airport give Vanguard. He say “It’s funny. When he come, he shake
hands with us and after shaking the players, he ask where is the coach?.
Everybody start to laugh. We shake  hands again and hug join”.  “The environment before the Game no good at all, but we resolve to weather the
storm.

The players give dem best. Without just hailing one player, Mikel really dey outstanding. He No just only play well, he also motivate the squad with him leadership qualities. Injury no allow us use some other good players. Anyway, we dey very grateful.

No comments: