Tuesday, 28 June 2016
NA PAUL LE GUEN NFF WAN SIGN AS SUPER EAGLES NEW COACH
NFF don ready sign Paul Le Guan to be the new coach of Super Eagles and na $50,000 go be him salary and he must qualify Nigeria enter the world cup wey wan happen for Russia
NFF don dey yarn say na foreign coach dem want to be the new Super Eagles Coach, and dem don give am condition to qualify Nigeria go world cup for Russia.
But the Minister for youths and sports, Solomon Dalung been don yarn say If the Glass house the plan to employ foreign coach, the ministry hand no go dey to help pay him salary as he know say foreign coach go dey expensive to maintain.
Paul Le Guan been don coach Cameroon, Omar and clubs like PSG and Lyon. Na $50,000 go be him salary and him condition na to qualify Naija go Russia world cup.
*I dey think coaching career now.. Lol*
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment