Pages

Wednesday, 29 June 2016

NAIJA NO FIT AFFORD TO DEY PAY FOREIGN COACH NOW - - SOLOMON DALUNG


The Minister for sports and youth development, Solomon Dalung don yarn say Naija no fit afford to pay any foreign coach now. 
Dis yearnings dey come after NFF yarn say dem go employ foreign coach and na $50,000 dem go dey pay am as salary, just to qualify Nigeria go the world cup wey go happen for inside Russia.

Solomon Dalung don react to dem decision as he say Naija no go fit dey pay the foreign coach, he say how the glass house wan take manage to dey pay the coach as e be say NFF never fit dey pay our indigenous coach dem compete salaries. He say some of the ingenious coach dem sef no collect dem complete salary before now, and he sure say dem owe some till death.

The Minister say the employment of the foreign coach for now no too make sense as the naija economy still dey struggle to maintain dem sef.






No comments: