Pages

Friday 10 June 2016

OSUN CAN DON ORDER CHRISTAIN STUDENTS TO DEY GO SCHOOL WITH DEM CHURCH GARMENT


The chapter of Christain Association of Niger for Osun State, OSCAN, don order all christain students to dey wear dem church garment go school, starting from Monday.
Dis decision dey come after the Osun State government lift the ban on the use of hijab for the state, to dey allow Muslim girls to wear hijab dey go school after dem been first ban the use of hijab for public schools inside the state.

The Christain Association leaders don give directives say make Christian female students sef the wear dem church garment go school too. Dey yarn say the state na for all, so now the Christain students fit dey wear dem church garment or uniforms like usher, chior, boys brigade or girls guide or dem white, red, blue or any color wey be dem church garment.

Osun State PDP don yarn say make Nigerians hold Governor Rauf Aregbesola strong if dis Gbege affect the educational sector of the state. Na the spokesperson of the party for Osun  Prince Diran Odeyemi yarn dis yearnings. He say Christians and Muslims dey live in harmony for the state o, but dis matta fit cause Gbege and if e be so, make pipu hold the state Governor, Rauf Aregbesola strong.

The state solicitor General, Abiola Adewemimo don con address the matta.. See the yearnings





No comments: