Pages

Wednesday, 13 July 2016

DINO MELAYE DON YARN.. I NO SAY I GO BEAT REMI TINUBU O!


Sahara Reporters been carry gist of wetin happen between Dino Melaya and Remi Tinubu after small aguement happen for The House yesterday. 


The cause of the argument na say make Sitting Senators dey get Immunity. As e be now, Senate President, Bukola Saraki and him vice Ike Ekweremadu dey face forgery case and senator Dino feel say na falling hand for the Senate dem, so he dey support say make dem give sitting senators dem immunity.

Meanwhile, senator Remi Tinubu yarn say why e be say na now dem wan dey bring dat kind law, as no sitting senator in the world get immunity, she say make dem No use dis matta downgrade the House.

After dat statement, we hear say Gbege happen and many pipu blood  begin boil. Sahara Reporters yarn say Senator Dino Melaya been threaten to beat Senator Remi Tinubu and even give her Belle.  Senate Dino don react to the report ontop his twitter handle...





No comments: