Pages

Sunday 12 June 2016

50 PIPU POOFF AS 53 PIPU WOUND FOR THE GAY CLUB ATTACK FOR ORLANDO USA.


No be small matta for one Orlando gay night club as one guy begin spray pipu with bullets inside the club, sake of say dem be GAY on sunday early morning, before police con pooff the guy.
Na riffle and handgun the attacker take carry out the massacre as him dey yarn say him dey vex as he see two guys dey kiss. The matta happen inside Pulse Night club for Orlando Florida.

The law enforcement agencies do  identify the shooter as Omar Mateen, and him na US born citizen, from Port St. Lucie, Florida, but him parents na from Afghanistan. Na 1986 dem born Omar for USA.

Na SWAT team con pooff the shooter after he hold many pipu as hostage inside the club, he still attack police officer wey dey secure the club before SWAT pooff am. The Florida department of law enforcement, special Agent Danny Banks yarn for news conference say him believe say dis na terrorism attack, so Investigations dey go on to know whether the guy na terrorist wey dey work alone, or he get gangs.




1 comment:

Unknown said...

Nawaoooo!
Pipu too dey vex!....