Pages

Sunday, 3 July 2016

FRANCE WIPE ICELAND 5-2 TO MEET GERMANY INSIDE THE SEMI-FINAL OF THE EUROS.


Na total domination France take arrange dem victory today as Olivier Giroud open the scoring goal.. 


Paul Pogba con make am two with header from one corner-kick, na Payet score the third goal with him weak foot, Griezmann sef join the party of goals as him score the fourth goal for France. Na 4-0 France take lead Iceland for first half.

Iceland threaten with long throws but e no easy for dem to get their groove for the match. For the second half, Sigthorsson score one goal back for Iceland inside the 56th minute.

Giroud make am five for France inside the 60th minute from one beautiful freekick wey Payet play.



Iceland try score one goal again to make am 5 –2.
Na so France take qualify enter the semi-final stage wey dem go meet Germany for the match wey dem go play on Thursday

No comments: