Sunday, 3 July 2016
CANABIES 'IGBO' ATM MACHINE GO SOON START TO WORK FOR JAMIACA
After dem decriminalized IGBO smoking for inside Jamaica last February, Jamaica don dey plan to open IGBO 'cannabis ATMs’ for dem airports and harbours to welcome tourists
So dat the tourist dem go get the chance to taste and enjoy dem IGBO 'weed' as soon as dem land for the country. The Cannabis Licensing Authority (CLA) don start to see ways to introduce special dedicated desks where visitors go fit get licence for the ‘good herb’ IGBO. As e be now, e dey legal to carry up to two ounces of weed for inside Jamaica.
Although police still get the power to issue anybodi with possession of more than two ounces ticket and J $500 (£2.98) fine.
So with the IGBO ATM MACHINE, pipu go just put dem ATM card, type the amount of ounces of IGBO wey dem want and the ATM go bring am out like money. The ATM sef go dey help dem monitor the pipu dem as e no go release pass two ounces of IGBO wey the machine go bring out.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment