Pages

Thursday, 21 July 2016

SEE ACCOUNTING GRADUATE WEY DEY HAWK FOOD INSIDE WHEELBARROW FOR EKPOMA , EDO STATE

 

One Facebook user, Daniel Usifoh, him na man and na university graduate wey dey hustle to make money as  he dey cook food dey sell with wheelbarrow for one motor park inside Ekpoma, Edo State. 

The man say.. "I see dis man as I dey on my way to PH, he dey hawk cooked food inside wheelbarrow dis morning for Ekpoma, Edo State. I dey moved to patronize the guy even say I never hungry. Guess what? Him na accountant, he graduate 4yrs ago but he No get any job. He decide to go  catering school.

Today he don start him own business of cooking, hawking and selling for the streets of Ekpoma where he from graduate to start the new business of cooking wey he just learn. I ask am say why he decide to do dis level? See as he take answer me. He say "bros wetin I go do na, since no job anywhere and na me be the first son of my parent I decided to go this way instead of to become armed rubber to take care of those wey take care of me from childhood before dem die with regrets". Him na Igbo man... I respect him courage...."

*Nigerian Graduate dey hawk food with wheelbarrow just to make money.. Chai, after plenty school fees and years for school, see wetin dis country dey do Man Pikin.. *

No comments: