Pages

Wednesday 24 August 2016

ARSENE WENGER SAY 'I SPEND ARSENAL MONEY AS IF NA MY OWN, DATS WHY I DEY FEAR TO BUY PLAYERS.


Arsenal manager, Arsene Wenger, don admit say he dey treat the club money as if na him personal money.
The Gunners oga, wey pipu dey say he too stingy with the transfer market, confess say he dey  nervous not to make mistakes anytime we wan buy players. Arsene Wenger say: “I personally believe say the only way to be a manager na to spend the club money as if na your own, becos if you do so, you fit dey do too many mistakes with signings.

 “You make big decisions and I believe say you have to act like say na your own money — like you’re the owner of the club and you fit identify completely with the club, because if
you no do so, I think say you no go fit go far.”

Abeg, na the work wey Arsenal fans send ARSENE WENGER be dat? Abeg sign big players so u go fit win Big trophies. Na your money? Why u come dey stingy? Manage ur own money, spend the club money.



No comments: