Pages

Wednesday 24 August 2016

NATIONAL ASSEMBLY DEY BROKE- SENATE LEADER ALI NDUME.


Senator Ali Ndume, yarn newsmen for Abuja say the National Assembly dey broke and say legislators never get dem allowances on time.
He say: “I know say the whole country dey financial difficulty, no be only National Assembly. I dey the National Assembly since 2003, but things just Dey get worse; I think dey pay us last month’s salary on the 16th of the following month or thereabouts,“No be only with the National Assembly, some states sef never for dey able to pay salaries for six months, one year. “Some states dey even ask their workers to go farm for two days and work for the other three days in a week.

“Even for the Presidency, dem don  tighten their belts ontop their expenditure and so, na general phenomenon for the country. “We been dey receive running costs or allowances quarterly but now na monthly and e no dey come as when due.


E don red O, very soon dis guys go carry placards go Street to protest abt dem allowances. 




No comments: