Pages

Friday 19 August 2016

ELECTRICITY POOFF ONE ELECTRICITY POWER STAFF TODAY FOR KANO.


One 37 year old official of the Kano Electricity Distribution Company [KERDCO], Usaini Usman, pooff as electricity electrocute am as he dey try to  disconnect one electricity cable for Kano today August 19th.
Usaini pooff after him head manage contact one high tension power line for the Federal College of Education, Kano. Dem sharperly rush go the Murtala Mohammed Specialist Hospital na for there dem confirm am dead.

Na the deceased foto be dis.. RIP.



Na wa O, I wan specially beg Nigerians, make we stop to dey swear for the Power Holding Company dem, the swear wey dey dem head since the era of NEPA still dey worry dem. Na beg I beg, make we stop to swear for dem. Thank you. 

No comments: