Pages

Thursday 25 August 2016

KANO PILLARS DON SIGN CHIEF JOSEPH YOBO.


Joseph Yobo,35, don agree to join Northern club, Kano Pillars after the NPFL club beat three other clubs to get him signature.
Alhaji Shehu Dikko, Chairman of the League Management Company, LMC, for one interview with Completesportsnigeria on Tuesday reveal say Kano Pillars na the club wey appeal most to the footballer dem fit meet him demands. “Kano Pillars”, Dikko yarn when
Completesportsnigeria.com ask am which club Yobo go eventually play for in him celebrated return to the Nigerian domestic top flight.

Dem still ask am when Yobo go turn out for Kano Pillars, wey don win four league titles, Dikko say:  “For now, dat one dey worked out, but we dey  look ahead of the next (home)
game,” Dikko yarn on Tuesday for the unveiling of the LMC partnership deal with Star beer, as the official beer of the Nigeria Professional Football League for Eko Hotel and Suites, Lagos. Joseph Yobo na ambassador of the Nigerian Professional Football League and dem hope say him presence for the league go help increase stadium turn out and go also improve the league.

I hope say the strategy go work becos i believe say na good move. Many Brazilian players sef dey return home to play for dem local League. 

No comments: