Pages

Thursday 25 August 2016

MIKEL OBI DON RETURN TO CHELSEA AFTER THE OLYMPICS SUCCESS.


Mikel John Obi don return to Chelsea, after he don help Nigeria U-23 team win bronze for the 2016 Olympics inside Rio, Brazil.
The Chelsea midfielder na the Dream Team VI captain, he score once and give four assists, as Samson Siasia men win Naija only medal. Mikel don go back to Stamford Bridge, where he go battle for starting place under new manager, Antonio Conte.

“Back in the UK. Now hard work with #C FC begins. Eleven seasons, Eleven trophies and I’m not done yet,” Mikel Obi write ontop Twitter. Chelsea dey host Burnley dis Saturday.

I wish am the very best becos he really perform well for the Olympics. E be like say na only coach Siasia get Mikel playing manual. Siasia Sabi use Mikel to perform well, na. So i see am. 




No comments: