Pages

Sunday 21 August 2016

MANCHESTER CITY DEAL WITH BARCELONA GOALIE, C. BRAVO DON SET.


Barcelona don announce say, the agreement to sell goalkeeper Claudio Bravo to Manchester City don set.
Sky Sports’ Spanish football expert Guillem Balague, report on Friday say the clubs dem don agree the fee and Bravo family dey insist say dem dey move to Manchester. But he still yarn say Barca boss Luis Enrique dey find replacement and na wetin dey hold up the deal, the Catalan club’s technical secretary Robert Fernandez don suggest say dem dey wait to secure new ‘keeper before dem allow Bravo to move on.

Fernandez yarn onto Barca official Twitter account after the 6-2 thrashing of Real Betis on Saturday: “We don begin the agreement with Manchester City for Claudio Bravo. “We dey wait to see how the events go be dis week.

When Claudio commot, we hope to get new keeper” Man City get strong desire to sign Bravo, and dat one don make England No 1 Joe Hart to dey reason him move from the Etihad Stadium, after more than 10 years for the club.

Which big club go for England go wan buy Joe Hart now? Guardiola sha! The man like better thing, hope he go fit deliver dis season. 





No comments: