Pages

Tuesday 23 August 2016

MIKEL OBI DON DONATE HIM SHARE OF $200,000 GIFT FROM JAPANESE SURGEON TO HIM TEAMMATES.


After the Japanese multi millionaire surgeon Katsuya Takasu fulfill him promise to
donate $390,000 to Nigeria team wey win Bronze for the Rio 2016 Olympics,
reports dey now say Mikel Obi don  agree to donate part of him own share to him U-23 teammates for the just concluded Rio 2016. Some reports been reveal say the NFF been wan take some share of the gift from the surgeon, but the NFF for weekend don dismiss the reports with some series of tweets, as dem claim say dey just only want ensure due process. “Mikel don insist say all of us go get our share of the money. Say make we no mind wetin the people for NFF dey yarn.' one of Nigeria Under 23 players yarn AfricanFootball.

“He go make the cash available when he come for next month AFCON qualifier against Tanzania for Uyo.” ''One team meeting don already resolve say both players and officials go collect equal amount of the cash as Mikel himself don agree to give part of him own share to the chief coach (Siasia) to get more than the rest of the squad.'' 'The sharing formula dey agree on flat rate for the 22 players (18 accredited players and four alternate players) and 10 officials.''

Mikel dey earns about £75,000 per week for London club, Chelsea. So him na Big boy to release him share. How many captains fit try am? Mikel show say him na real leader! 




No comments: