Monday, 5 September 2016
BUHARI FREE TO CONTEST ANOTHER ELECTION FOR 2019 – OBASANJO YARN.
Former President Olusegun Obasanjo on Sunday yarn say President Muhammadu Buhari dey free to contest another election. Obasanjo yarn as reaction to one report say he don advise Buhari not to seek re-election.
Alex Nwokedi, the ex-president’s chief press
secretary (CPS), been yarn the comment on Obasanjo behalf. Obj don Describe the report as completely false and destructive, Obasanjo say the last time he communicate with Nwokedi na three years ago.
“My belief na say democracy dey allowed for anybody including President Buhari for that matter to contest any election and na the prerogative rights of Nigerians to vote or not
to vote for dem,” na the statement issued on behalf of the ex-president by Kehinde
Akinyemi, him media aide. Continue…“I never communicate with Alex for the last three years, so how him story go dey credited to me, when I no authorize am or communicate with am for the last three years? I condemn in the highest manner the story and the pipu behind am. And those wey dey behind am na just enemies of democracy and freedom of expression.”
I think I like dis part of the statement.. “My belief na say democracy dey allowed for
anybody including President Buhari for that matter to contest any election and na the prerogative rights of Nigerians to vote or not.
to vote for dem,”.. Abi na.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment