Wednesday, 7 September 2016
BUHARI SAY NIGERIA GO SOON COME OUT FROM ECONOMIC RECESSION.
President Buhari yesterday don assure Nigerians say him government go soon commot the country from the present economic recession wey we dey experience.
President Buhari give the assurance as he yarn for the APC governorship campaign rally for inside Edo State yesterday September 6th. He say:
“I assure una say we go get out of our economic problems. We don almost dey out of our security problem and we go try make Nigeria greater again. We go dey very proud of our country once again, our size, our resources no go be for nothing. We go continue to grow.”he say we go soon come out of economic recession soon.
*Ok, na now I confirm say Nigeria dey real recession, no be 'technical recession' wey dem call am.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment