Wednesday, 7 September 2016
IHEANACHO DEY READY TO REPLACE AGUERO AGAINST MANCHESTER UNITED ON SATURDAY.
Manchester City star, Kelechi Iheanacho don dey ready to replace Sergio Aguero for dis weekend Manchester derby for Old Trafford.
Aguero wey don dey three-match suspension as he attempt to elbow West Ham defender Winston Reid, so he go miss Man City trip to United on Saturday. Iheanacho, 19, say Aguero absence don leave big hole for dem side – but insist say he fit fill the space if Pep Guardiola selects am. “Sergio suspension na big loss but we get plenty big players to turn to,” he yarn The Sun.
“If I get picked, I go do my job. Games like dis mean a lot and na for dis kind big derby the games the matter.' Guardiola dey impressed with him quality
– and the Iheanacho, wey scored one wonderful goal for Nigeria last weekend, dey Enjoy life under the Catalan.
We hope say Iheanacho go seize dis chance to finally get full starting games for Man City like Aguero!!!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment