Pages

Thursday, 15 September 2016

Lol. 70 YEAR OLD MAN ROB BANK TO ESCAPE TO LIVE WITH HIM WIFE. (WOMAN WAHALA)


One 70 year old Kansas man, Lawrence John Ripple, yarn authorities say he just rob one bank becos he want go jail instead of to continue to live with him wife.
According to Ripple affidavit, he write out him demand note for front of him wife and yarn her say he rather go jail Dan to continue to live inside the same home with her. The man just waka go one Bank for Kansas City, Kan., bank last week, he drop one teller with one note wey  read say, "I have a gun, give me money,".

According to the Kansas City Star, the teller give  one bag of cash to Ripple, after he collect the money, instead make he run with the cash, he find better corner sitdon for inside the bank lobby until police show some  minutes later. Dem say na him personally tell the security guard wey approach am say na him be "guy wey he dey  look for."

Ripple, now dey face federal charges, but he later tell FBI agents say he and him wife been get one fight and he no "want dey dat kind situation."

*Which kind punishment fit dis man, make he go jail or make he go back to him wife?

No comments: