Monday, 5 September 2016
OPERATION CROCODILE SMILE SUFFER LOSS AS 2 SOLDIERS DROWN FOR BAYELSA BOAT MISHAP.
Two soldiers wey dey part of the Operation Crocodile for Niger Delta don drown as dem boat capsize for Bayelsa state today September 5th.
The incident happened at about 10 am this morning along the Brass Water Front for Brass
Local Government Area of Bayelsa. The riffles of the soldiers dey missing till now. One resident of the community, Effa, wey yarn with Leadership, say attempts by the youths for the community and other soldiers to rescue the soldiers fail as the soldiers wey drown never still dey found. “recently ,we don dey notice plenty movement of soldiers for our
area. The boat wey capsize been dey carry new batch of soldiers go the water front.
I wan go throway dirty for the waterfront and I see uniformed soldiers struggling to rescue
their colleagues for one capsize boat. When the confusion cool down, two Soldiers dey miss with their rifles and other military gear. Some others wey dey rescued sef lose dem rifle as dem dey struggle to commot from the water. “ na so he yarn.. Search for the missing soldiers and their riffles still dey ongoing.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment