Sunday, 4 September 2016
SEE AS MAN POOFF AS HE DEY TRY TO PURSUE DANFO DRIVER WEY BASH HIM CAR FOR LAGOS. (GRAPHIC FOTO)
The pipu of Maryland area for Lagos dey in shock yesterday morning after one commercial bus a.k.a ‘Danfo’ hit and pooff one man wey dey on him way to him office.
According to eyewitness, dem say the man na one managing director for one of the offices wey dey the area -he pooff as he dey try to pursue the Danfo driver wey bash him car. The man leave him car, commot him shoes con run pursue the bus driver, according to report. As e dey try to hold the bus and the run away driver, the driver push the man commot, as he fall for ground na so another motor with speed just accidentally hit am for head as the man fall enter the upcoming traffic way. He pooff on the spot.
Na Wa! Dis death for no happen if only the man just free the DANFO driver, we all know say kolo dey some head. Abeg, watch your anger!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment