Pages

Wednesday, 14 September 2016

WALKER DESIGN OFFICIAL LAUNCH FOR WARRI HOLD GROUND STRONG. SEE SOME FOTO.

Mc ogheneonetouch, guest, koko Walker, Chief HP and Onos for WALKER DESIGN 

The official Launching of WALKER DESIGN wey happen on saturday 10th of September for Warri hold strong ground no be small.
Plenty pipu turn out to follow witness the unveiling and to follow join body celebrate with the CEO Mr, Adegoke Kolade, aka 'Koko Walker'. Na me, myself and I Mc ogheneonetouch host the event and I take small time to ask koko Walker about him feelings..



he yarn say 'Bros, na God O, na God bring the inspiration, concepts. I really appreciate the love wey pipu show me today, and I want make dem know say WALKER DESIGN no go ever disappoint dem with standard and quality. As una know, WALKER DESIGN na the quality wey U fit trust." na so he yarn. WALKER DESIGN DEY use authentic African fabrics with good professionals to deliver your perfect design.


U fit pre-order for any fabric, design or accessories wey U want from WALKER DESIGN online or on site for dem show room. Plenty new arrival dey available now for sale.






1 comment:

Unknown said...

Thanks Onetouch. God bless you.